Asake vs Seyi Vibez Who Be The Real King of Street Music in 2026
For street for Ikorodu, for Lagos, for Nigeria — two names everybody dey argue: Asake and Seyi Vibez. Na dem dey control street for 2 years now. But who be the real king?
As DJ wey dey play for street party everyday, I go break am down.
ASAKE- MR MONEY
Asake style na Fuji plus Amapiano plus spiritual vibe. From O2 to Lonely At The Top, e show say street fit enter international. His voice unique.
Strength: Stage performance mad, songs dey hit club and church at same time.
SEYI VIBEZ - NSNV
Seyi Vibez na pure street pain plus melody. Songs like Different Pattern, Chance, Bad Type — na real life story. Young boys for street connect to am quick.
Strength: E dey drop song every month, e no dey miss.
MY VERDICT AS DJ BARLOWZEEZ
If na international plus dancefloor, Asake win small.
If na pure street plus everyday waka, Seyi Vibez na king.
For my own mix, I dey play both — but if party hot and I need crowd to shout, I go play Seyi Vibez first, then Asake to finish am.
Wetin you think? Who be your king? Drop for comment.
Listen to my mix here on Audiomack - search Street Vibration by DJ Barlowzeez
Follow for more updates.@realbarlow

I prefere Asake
ReplyDeleteWho I go Afolabi OluwaLoseyi for?? ☹️❤️
ReplyDelete